Brymo – Patience and Goodluck Lyrics

African

If you get drunk, e go be like say you don know enough
And if you smoke grass, e go be like say you wan know a lot
But I know something wey you no know at all
Say to take time, you go make time, I talk am before-before

Some people know say
Say the drug for sorrow na attitude
If you wait you, go soon find am say
Good times go come around again

Patience and goodluck
Dem dey close like hair and skin

If you love somebody
Only to find say you no love them again
And the fire wey dey burn don quench
You no feel am again
Well, me I know say the passion wey die
Fit to rise again
To take time you go make time
I dey talk am again and again

Some people talk say
Say to wait na a waste, na pain
If you try you, go soon find am say
Good things go come and here to stay

Patience and goodluck
Dem dey close like hair and skin

Some people talk say
Say to wait, na a waste, na pain
If you try you, go soon find am say
Good times go come around again

Comments (0)