STYL-PLUS – Iya Basira Lyrics

Se won sa si eni yo olumi da aa e hon ton ara yin aa e se
Wo get out from my way idiot what is it madam let me have let me have my food please let me have my food
Ooh boy nawa o make dis people no come fight break sometin here
Ooh boy dis food sweet no bi small o
Dis na one buka wey I dey like to go
De food sweet sote e go make your mind blow
Day and night Iya Bas how she do am I no know
Dey think say na jazz my broda no be so
People people make una com mi o
Iya Basira e don jazz me o ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una com mi o
Iya Basira e go kill mi o ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my mother or my girlfriends food
Long troat na food go kill you haa no be so
I say na food go kill you o o oga mi no be so
Wetin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday
Na so I reach there but Sunday e don high on beer
Luckily for me him junior broad eye e clear
He say make we stroll to the area little did I know that I was strolling to my burial
Right dere wey Oshodi bus dey load
Was a little buka close to the mainroad
I laugh when e pass the door
E tell me say de name na Iya Bas for short
But I bow when e order
Iresi ate ewa eron hmm hmm purewater not even mineral
I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order second round third round forth round
I never still stop
Wetin Iya Basira e give me chop ehnh
People people make una com mi oo
Iya Basira e don jazz me o ooo e don jazz me o ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place at my mother or my girlfriends
People people make una com mi oo
Iya Basira e don kill me o ooo she go kill me my broda o
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my mother or my girlfriends food
Long troat na food go kill you haa no be so o
I know hehn na food go kill you oga mi
You think say na play wen I say na the way wey I dey wetin do am e no day ok
Wetin be your own advice I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice
Even on my girlfriend birthday
When she dey wait make I take am to Ocean View
I no know when I pass the place
De only thing wey dey my mind na Iya Basira palm oil stew
Ah
Kilon kilon shele shele
Me I never see dis kind juju telle telle
All those people wey go vex pele pele but I hear say Iya Basira na belle belle
I sure say still I go go there go sidon
Order my first round move to second round third round forth round I no dey ever stop
Wetin Iya Basira come give me chop
Mo gbe ee
People people make una com mi oo o make una com mi o o
Iya Basira e don jazz me o ooo oti sunmi oo
Everybody helep save me o hey hey
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una com mi oo o am in trouble oo
Iya Basira e go kill me o ooo egba mi oo
Everybody helep save me o abegi oo
I no dey sabi chop again my mother or my girlfriends food
Officer abegi follow me to de place
Everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me my mother no gree see me
My paddy hmm
Iya Basira e don killie me
Officer abeggi follow me to de place
Everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me my mother no gree see me
My paddy eey eh
Iya Basira e don killie me uhoohi
Oya people people make una stop officer e don come
Where the woman
Hin dey inside oga I dey come
Woman na wetin you dey give people chop
Wey dey cause all dis wahala casala oya make we talk
Oga Sir true to God
Nothin wey I dey put for the food wey I dey cook
Na God dey make am good
Na which kind talk be that
Say na God dey cook the food
Abi u think say I be fool no be juju u dey put
Infact I dey suspect say na you wash put
Sote people dey queue come dey rush for your stew
Well to confirm am me I no mind make I chop small
Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw
Chaii correct this food sweet no be small
Shey una no go vex if I still order for more
Officer no worry na the food be this
Oya people people make una go
Case dismiss
People people make una com mi oo o mo gbe ee
Iya Basira e don jazz me o ooo egba mi oo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place ooh oh oh oh
People people make una com mi oo o plenty trouble
Iya Basira e go kill me o ooo
Everybody helep save me o shey na me be dis oo
I no dey sabi chop again my mother or my girlfriends food
People people make una com mi oo o wahala
Iya Basira e don jazz me o ooo dis na palaver
Everybody helep save me o oh yeah eh I dey haala haala
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una com mi oo o
Iya Basira e go kill me o ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my mother or my girlfriends food

Comments (0)